1 Na dis bi family wey Noah shidren: Shem, Ham and Jafet born, afta di flood happen.
2 Jafet shidren na
3 Gomer kon born
4 Javan shidren na
5 Na dem bi di grand-grand papa to di pipol wey dey di land wey wota surround. Na dem bi Jaflet shidren-shidren.
6 Ham shidren na
7 Kush shidren na
8 Kush na Nimrod papa, dis Nimrod kom bi warrior for di eart.
9 En na strong hunta for Oga God front. Dat na why dem dey sey, “Just like Nimrod wey bi strong hunta for God present.”
10 For di first time, en kingdom na Babel wey bi Babilon, Erek, Akkad and Kalneh wey dey Shinar land.
11 From dat land, e kon go Assyria where e for build Nineveh, Rehobot, Kalah
12 and Resen where dey di centre for Nineveh and di great town wey bi Kalah.
13 Mizraim (wey bi Egypt naw) shidren na
14 Patrus, Kasluh (na from dem Filistia pipol from kom) and Kaftor pipol.
15 Kanaan shidren na
16 Jebus, Amor, Girgash,
17 Hiv, Ark, Sin,
18 Arvad, Zemar and Hamat pipol. Leta, Kanaan family kon skata
19 and dia land kon wide from Sidon to Gerar go rish Gaza and from der to Sodom, Gomorrah, Admah and Zeboiim till e rish Lasha.
20 Dis na Ham shidren akordin to dia family, dia language, lands and kountries.
21 Dem still born some sons give Shem (wey bi Jafet senior broda) and na Shem bi papa to all Eber sons.
22 Shem shidren na
23 Aram shidren na
24 Arfaxad na
25 Eber get two sons:
26 Joktan shidren na
27 Hadoram, Uzal, Diklah,
28 Obal, Abimael, Sheba,
29 Ofir, Havilah and Jobab dem na Joktan sons.
30 Where dem dey stay na from Mesha go rish Sefar for di hill for east.
31 Dis na Shem sons akordin to dia family, language, lands and kountry.
32 Dis na Noah family akordin to dia generashon, kountry and dia pipol kon full di eart afta di rain don fall finish.