1 Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di twelft mont, God kon tell mi.
2 “Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu:
3 Wen many kountries gada,
4 I go trow yu for groun
5 I go spread yor rotin flesh
6 I go pour yor blood from groun
7 Wen I don distroy yu,
8 I go off all di lite for heaven
9 “Di kountries wey yu neva hear of before,
10 Wetin I do yu go make many kountries dey fear
11 God wey get pawa kon tell Egypt king sey, “Babilon king go kom fight yu.
12 “I go let sojas from kountries wey get pawa,
13 I go distroy all yor animals
14 Den I go make di wota kwayet again
15 “Wen I don make Egypt land empty
16 Dis warnin wey I dey give dem naw so,
17 For di Fifteent day for di first mont for di twelft year, God kon tell mi:
18 “Man pikin, kry for Egypt pipol. Send dem with di oda kountries wey get pawa go where dead body dey.
19 Tell dem sey, ‘Who una tink sey una fine pass? Una go-go where dead body dey kon follow wiked pipol stay der.’
20 Egypt pipol go fall with doz wey die for war. Yes! One swod dey ready to kill all of dem.
21 Pipol wey dey strong for dis life before dem die and doz wey fight for Egypt before, go welkom Egypt pipol wen dem kom where dead body dey. Dem go shaut: ‘Wiked pipol wey dem kill for war don kom relax for here!’
22 “Assyria pipol dey der with all en sojas grave. All of dem die for war
23 and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.
24 “Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
25 Among doz wey don die, dem make somewhere for Elam and en pipol. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
26 “Meshak and Tubal dey der too and en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
27 Dem nor beri dem as dem bin dey beri pipol wey really fight and die for dia kountries; pipol wey dem beri with dia swod under dia head and dia shield for dia body. Dis pipol dey make pipol fear wen dem dey alive.
28 “But naw, dem go win una and una go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
29 “Edom dey der with en kings and rulers. Dem bi sojas wey get pawa, but naw, dem don die kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
30 “All di prince for nort plus Sidon pipol dey der too. Even with all di pawa wey dey make pipol fear before, dem still die with shame kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
31 God wey get pawa sey, “Wen Egypt king and en sojas go si doz wey dem kill for war, belle go sweet dem small.
32 Aldo, na mi worry Egypt king wen e dey alive, so en and en sojas go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”