1 God kon tell mi again,
2 “Man pikin, go tell Egypt pipol wetin mi God wey get pawa dey tok.
3 Di day wen God go take akshon,
4 War go dey for Egypt
5 “All di sojas wey dem hire kom from Sudan, Libya, Lydia, Arabia, Put and even from among my own pipol, go die for dat war.”
6 God sey,
7 “Na di land go empty pass for di world
8 Wen I don put fire for Egypt
9 “For dat same day afta I don distroy Egypt finish, I go send messenjas for ship go tell Ethiopia pipol sey wahala dey kom. Dem dey tink sey dem dey save, but naw, fear go katch dem.”
10 God wey get pawa sey,
11 En and en wiked sojas go kom
12 I go turn River Nile to dry land
13 God wey get pawa sey,
14 I go make di sout-side for Egypt empty
15 Pelusium, Egypt town wey get all dia betta tins,
16 I go burn Egypt town
17 Di yong men wey dey On and Pi-Beset town
18 Darkness go kover Tahpanhes town
19 Wen I don ponish Egypt like dis,
20 For di elevent year afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di sevent day for di first mont, God kon tell mi sey:
21 “Man pikin, I don break Egypt king hand. Nobody fit bandage am or do wetin go make am well or strong again and e nor go fit whole swod again.
22 Naw, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok: ‘I bi Egypt pipol enemy. I go break di king two hand; both di one wey good and di one wey don break before, den en swod go fall for groun.
23 I go skata Egypt pipol go difren place for di world.
24 Den I go make Babilon king strong kon put my swod for en strong hand. But I go break Egypt king hand and e go kry kon die for en enemies front.’
25 Yes! Na mi make am weak, so dat Babilon king go strong. Wen I give Babilon king my swod and e point am face Egypt, evribody go know sey na mi bi God.
26 I go skata Egypt pipol for evriwhere for di world. Den, dem go know sey na mi bi Oga God.”