1 Nine years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di tent day for di tent mont, God kon tell mi sey:
2 “Man pikin, make yu rite today date for groun, bikos Babilon king go seize Jerusalem.
3 Make yu go tell my sturbon pipol dis parabol wey mi, God get for dem:
4 Put di betta part for di meat inside:
5 Na di sheep wey fine pass,
6 Dis na wetin God wey get pawa dey tok:
7 Di pipol wey e kill,
8 I don leave di blood for der;
9 Dis na wetin God wey get pawa dey tok,
10 So make una still bring wood kom!
11 Naw, put di empty pot on-top di shako,
12 But all dis yeye tins nor go vanish
13 Jerusalem pipol!
14 “Mi God don tok. Di time don rish for mi to do wetin I won do. I nor go let una sin finish kon go like dat or sorry for una. I go ponish una for wetin una don do.”
15 God tell mi.
16 “Man pikin, na one blow I go take kill di pesin wey yu love pass. Make yu nor tok or kry.
17 Nor let pipol hear yu kry. Nor skrape yu head or waka with ordinary leg like sey yu dey mourn. Nor kover yor face or chop di kind food wey pipol wey dey mourn dey chop.”
18 So for early morning, I tok to di pipol. But my wife die for evening and di next day I kon do as God tell mi.
19 Pipol kon dey ask mi, “Wetin make yu dey bihave like dis?”
20 I ansa dem, “God sey make
21 I tell Israel pipol dis message: ‘Una dey happy, bikos of una temple. Una like to dey look and go der, but I go distroy am and di small-small pipol wey una get for Jerusalem go die for war.’
22 Den una go do wetin I don do so. Una nor go kover una face or chop food wey pipol wey dey mourn dey chop.
23 Una nor go skrape una head or waka with ordinary leg like pipol wey dey mourn. Bikos of una sins, una go die anyhow kon dey komplain give each oda.
24 Ezekiel go bi ezample to una; una go do evritin wey I don do. God sey wen all dis tins happen, una go know sey na-im bi Oga God.”
25 God kon sey, “Man pikin, I go remove di strong temple wey bi dia joy and pride. Di temple wey dem dey like to look and visit. I go still take dia shidren komot dia hand.
26 For di day wey I go do wetin I tell yu so, pesin wey go eskape di wahala go kom tell yu di news.
27 Dat same day, yor mout go open and yu go fit tok again. Yu go tok to di pesin wey eskape kom and dis go bi sign to di pipol, den dem go know sey na mi bi God.”