1 God tell mi:
2 “Man pikin, make yu prish against di temple for Jerusalem, where pipol dey go woship. Warn Israel pipol
3 sey mi wey bi God sey, ‘I bi dia enemy. I go kill all of dem with my swod, both bad and good pipol.
4 I go kill both good and wiked pipol! I go use my swod take kut and kill pipol from nort go rish sout.
5 Den evribody for di world go know sey, mi wey bi God don draw my swod kom out and nor-tin go let mi put am back.’
6 “So man pikin, make yu kry well-well, bikos dem don break yor heart. Cry with pain for where evribody go for si yu.
7 If dem ask yu sey wetin make yu dey kry, make yu tell dem sey, na bikos of di news wey dey kom. Wen di news kom, fear go katch dem well-well; dia hand nor go fit move, dia mind go fail dem and dia leg go dey shake. Di time don kom and na naw.”
8 God tell mi sey:
9 “Man pikin, tell di pipol wetin mi wey bi God dey tok:
10 “I dey sharp and klean swod
11 “I don polish my swod,
12 So man pikin,
13 “I dey test my pipol and if dem nor gri turn from sin kom meet mi, all dis tins go happen to dem.
14 “So make yu profesai
15 E dey make my pipol heart melt
16 Di swod go kut from rite and left!
17 Den, mi too go klap my hand
18 God kon tell mi:
19 “Man pikin, choose two road where Babilon king go pass kom with en swod. Di two road must start from di same kountry. Do sign post make yu put am for where di roads for start kon enter di kountry.
20 One road go show di king where e go pass rish Ammon town for Rabbah and di oda one go show am Judah road; di strong town wey dey Jerusalem.
21 Babilon king go stand near di sign post for where di road for start. E go shake di arrow, ask en juju kweshon kon shake di animal liver wey dem sakrifice, so dat e go know where e dey go.
22 Di arrow wey mark ‘Jerusalem’ dey for en rite hand! E go-go gada rams kon ready for war. Some ram go dey di gate and dem go build betta wall kon dig many whole.
23 Jerusalem pipol nor go bilive wetin dey happen, bikos of di agriment wey dem make. But na to make dem remember dia sins and to warn dem sey dem go katch dem go prison.”
24 So, dis na wetin mi God wey get pawa dey tok. “I don si una sins and evribody don know how una bad rish. Una sins dey show for evritin wey una dey do. Naw, God go kondemn and give una to una enemies.
25 Una wey bi wiked and bad leaders for Israel! Di day wey God go ponish una, dey kom.”
26 Mi, God wey get pawa, don tok.
27 I go skata una finish!
28 “Man pikin, make yu profesai. Tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell Ammon pipol wey dey curse Israel. Tell dem sey:
29 Di vishons wey una si nor bi true
30 So, make una karry una swod go back
31 Una go feel my vexnashon like hot fire.
32 Dem go distroy una with fire.