1 Den Moses and Israel pipol bigin sing dey praiz God sey,
2 Na God bi my pawa and Savior.
3 Awa Oga sabi fight war,
4 E trow Fero shariot,
5 Di deep sea kover dem;
6 My Oga God, yor rite hand
7 With yor pawa as King,
8 Yu breath from yor nose
9 Di enemies sey, ‘I go porshu,
10 But Yu breath from yor nose
11 My Oga God!
12 Yu stresh yor rite hand
13 With yor true love, Yu go lead di pipol
14 Oda kountries go hear wetin happen
15 Den Edom leaders go fear well-well;
16 Betta fear go katch dem
17 Yu go take dem enter inside di land
18 God go reign forever and ever!
19 “Wen Fero men with dia shariot enter di sea, Oga God kon make wota swallow dem, but Israel pipol waka pass for dry groun.”
20 Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.
21 Miriam sey,
22 Den Moses lead Israel pipol from di Red Sea enter Shur wildaness. Dem travel inside di wildaness for three days and dem nor si wota drink.
23 Den dem rish Marah, but dem nor fit drink di wota wey dey dat place, bikos e bitter (na dis make dem dey koll am, Marah.)
24 So di pipol bigin komplain give Moses sey, “Wetin wi go drink?”
25 Moses kry to God and God kon show am one stik. Wen e trow am inside di wota, di wota kon dey good to drink.
26 God sey, “If una really obey di Oga una God kon do wetin good for my eyes and listin to my kommand, I nor go sofa una with all di diziz wey I send go Egypt, bikos na mi bi di Oga una God wey dey heal una.”
27 Den dem go Elim where dem si twelf well and seventy palm tree. So dem kon stay near di wota.