Eclesiastes 4

PCM

1 Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world.

2 So I sey, e betta well-well for pipol wey don die,

3 But di ones wey dia own betta pass,

4 Den I tink of all di work wey pipol dey do and I kon si sey, evritin wey dem dey do, na to know who betta pass. But all dis tins dey yuzles too, e just bi like wen pesin dey porshu breeze.

5 Foolish pesin dey fold en hand and nor dey work,

6 E betta make yu get small propaty with peace for mind,

7 I still notis anoda tin for life wey dey yuzles.

8 E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda,

9 Two pipol betta pass one pesin,

10 Bikos if one pesin fall, di oda pesin go help am stand.

11 Na so too, wen two pipol sleep togeda, dem go fit make each oda body warm,

12 Dem fit attack and win one pesin wey stand alone,

13 E betta make yu dey poor and wise as youth, dan to bi old foolish king wey nor dey take advise.

14 Even if dem born dat youth for poor house or if e dey prison since, e fit kom out kon bi king for en town.

15 I don si for dis world as evribody dey follow one yong man wey dey lead dem afta di king die.

16 Even doh many pipol dey support am naw, anoda generashon go grow kon rijet am leta. So yu si, evritin dey yuzles and e just bi like wen pesin dey porshu breeze.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado