Apocalipse 5

PCM

1 Den I si sey di Pesin wey sidan for di throne, hold one book for en rite hand. Dem rite sometin put for di front and back kon lock am with seven keys.

2 Den I si one strong angel dey shaut with loud vois sey: “Na who dey holy rish to break di keys and open dis book?”

3 But nobody for heaven, eart or under eart fit open di book or look inside.

4 So I start to kry, bikos nobody dey holy rish to open di book or look inside.

5 Den one among di eldas kon tell mi, “Make yu nor kry again! Look, di lion for Judah tribe, wey kom from David family, don win. So e go open di book and break di seven keys.”

6 Den I si one Lamb wey bi like sey dem don kill-am, but e stand for di throne centre with di for creatures and di twenty-four eldas. E get seven horns and seven eyes wey bi God seven spirit, wey E send enter di eart.

7 Den e waka go kollect di book from di Pesin wey sidan for di throne.

8 And wen e take di book, di for creatures and di twenty-four eldas fall for di Lamb front. Each of dem whole harp and basin wey incense full. Dis incense na God pipol prayers.

9 Dem kon dey sing new song sey:

10 Yu don choose dem as kings and priests

11 As I dey look, I kon hear many tazon angels vois as dem stand round di throne; di for creatures and di eldas.

12 All of dem kon dey sing with loud vois sey:

13 Den I hear evritin wey God kreate for heaven, eart, under eart, sea and evritin wey dey inside dem dey sing sey:

14 And di for creatures kon sey, “Amen!” Den di eldas fall face groun kon start to woship God.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado