1 David sing dis song afta God save am from Saul and en enemies:
2 “Na di Oga awa God dey protet mi;
3 Na God dey protet and
4 I go praiz God, bikos wen ever I koll am,
5 Deat dey round mi;
6 Deat really dey around mi
7 Wen I dey trobol, I koll Oga God;
8 Den di eart bigin shake dey fear,
9 Smoke dey kom out from en nose,
10 E tear di sky open kon kom down
11 E dey fly with en shariot for heaven;
12 E kover ensef with darkness
13 Shako with fire dey kom out
14 Oga God dey bring tonda from di sky
15 E shot en arrow take skata en enemies.
16 Di river dry finish
17 God kom down from heaven kon hold mi.
18 E save mi from my strong enemies
19 Wen I dey trobol, dem attack mi,
20 Bikos E dey happy with mi,
21 God reward mi, bikos I do wetin dey rite.
22 I don obey God law;
23 I don keep all en laws;
24 E know sey I nor get fault
25 So E reward mi,
26 My Oga God, Yu dey faithful
27 Yu dey pure to doz wey dey pure,
28 Yu dey save pipol wey dey honbol,
29 Oga God! Na Yu bi my lite;
30 Yu give mi pawa take attack my enemies
31 Di tins wey dis God dey do, dey pafet.
32 Na di Oga bi God
33 Na inside God I hide put;
34 E make my foot dey save like deer
35 E dey train mi for war,
36 My Oga God! Yu protet and save mi;
37 Yu keep mi, so dat dem nor go katch mi
38 I porshu and defeat my enemies;
39 I nak dem fall and dem nor fit stand again,
40 Yu give mi pawa for war
41 Yu dey make my enemies run from mi
42 Dem dey look for help,
43 I skata and turn dem to san.
44 Yu save mi from my own pipol wey fight mi
45 Doz wey kom from anoda land
46 Anywhere wey dem hide put,
47 God go dey forever!
48 E give mi viktory ova my enemies
49 My Oga God! Yu save mi from my enemies
50 So, I dey praiz Yu among all di nashon;
51 God dey give en king great viktory.