2 Samuel 1

PCM

1 Afta Saul don die, wen David dey kom back from where e go fight and win Amalek pipol, e kon go stay Ziklag for two days.

2 For di third day, one yong man run kom from Saul kamp kon bow for David front. E dey kry with pain, bikos of wetin happen and e tear en klot kon pak dirty for en head.

3 David ask am, “Na where yu from kom?”

4 David kon sey, “Make yu tell mi wetin dey happen.”

5 David ask am, “How yu take know sey Saul and Jonatan don die?”

6 E ansa, “Na from Mount Gilboa I from si Saul as e knee down with en spear and I si sey di enemy shariot and doz wey dey ride dem don dey near am well-well.

7 Den e turn round and wen e si mi, e kon koll mi. I ansa, ‘Yes sir!’

8 “E kon ask who I bi and I tell am sey, I bi Amalek pesin.

9 “Den e sey, ‘Kom kill mi! Dem don wound mi well-well and I dey die.’

10 “So I kon go kill-am, bikos I know sey e go die. Den I komot di crown from en head and di shain from en hand. So my oga, I don bring dem kom give yu.”

11 David and all en men kon vex tear dia klot.

12 Dem mourn, kry and fast till evening for Saul, Jonatan and for God pipol wey dey Israel, bikos dem don kill many of dem for war.

13 David kon ask di man wey kom tell am di news, “Na where yu from kom?” Di man ansa, “I bi Amalek pesin, but na yor kountry I dey stay.”

14 David ask am, “Wetin make yu nor fear to kill di pesin wey God choose?”

15 Den David kon tell one of en men, “Make yu kill-am!” Di man kon kill di Amalek man,

16 den David tell di dead man, “Na yu use yor mout take kill yorsef: Yu kondemn yorsef wen yu sey yu kill di pesin wey God choose as king.”

17 David sing dis song as e dey kry for Saul and Jonatan

18 and e sey make dem tish di song to pipol wey dey Judah. (Dem rite di song for Jashar book.)

19 “Awa leaders die on-top hill for Israel!

20 Make yu nor announce am for Gat

21 Make rain or dew nor fall for Mount Gilboa,

22 Jonatan arrow nor stop to flow with pipol blood;

23 I love Saul and Jonatan well-well.

24 Israel wimen,

25 Di sojas wey strong well-well don fall,

26 Jonatan my broda, si as I dey kry for yu!

27 Di sojas wey strong well-well don fall and naw,

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado