2 Reis 19

PCM

1 Wen King Hezekaya hear wetin dem tok, en too tear en klot kon wear sak go God Temple.

2 E send Eliakim, Shebna and di priest oga with di sak klot wey dem wear sey make dem go meet Profet Isaya, Amos pikin, sey:

3 “Dis na wetin Hezekaya tok: ‘Today na bad day, bikos na curse and trobol full am. E just bi like wen woman wey get belle won born, but e nor get pawa to push di pikin out.

4 May bi di Oga yor God go hear all di tins wey di shief adviser sey Assyria king sey make e tok against God wey dey alive. Wen di Oga yor God hear, may bi E go ponish Assyria king for all di tins wey e tok. So make yu pray to God for awa pipol wey remain.’ ”

5 Wen Isaya hear King Hezekaya message,

6 e kon sey, “Make una go tell di king sey: ‘God sey make yu nor let Assyria king treaten yu sey, en wey bi God nor go fit save yu.

7 God go put one kind spirit for inside am wey go make am hear rumor, den e go-go back to en own kountry, den God go kill-am for der.’ ”

8 Wen di shief adviser hear sey Assyria king don komot from Lakish go fight for Libnah; e kon go der go meet am.

9 Di king hear sey, King Tirhakah for Ethiopia dey mash kon fight am. E kon still send message go meet Hezekaya sey:

10 “Make una tell King Hezekaya for Judah sey: ‘Make yu nor let di God wey yu trust fail yu wen E sey, “Assyria king nor go fit seize Jerusalem.”

11 True-true yu don hear wetin Assyria king do to di oda lands. Yu tink sey God go save yu?

12 Where di kountries wey my grand-grand papa dem distroy. Where Gozan, Haran, Rezef and di pipol for Eden for Telassar? Dia gods save dem?

13 Where di kings for Hamat, Arpad, Lair, Sefarvaim, Hena and Ivvah?’ ”

14 Hezekaya take di leta from di messenja kon read am, den e go God Temple kon spread am on-top di altar.

15 Hezekaya pray to God kon sey: “Oga wey bi Israel God, na Yu bi king among di creatures wey get feadas! Na only Yu bi God ova all di kingdoms for dis eart. Na Yu make di sky and di eart.

16 My God, make Yu listin well-well! Make Yu open yor eye si tins for yorsef! Listin to di message wey Sennakerib send kom and as e curse Yu wey dey alive!

17 “My God, na true sey, Assyria king don distroy all di kountries and dia lands.

18 Dem don burn di gods for di oda kountries, bikos dem nor really bi god, bikos na human being make dem with dia hand from wood and stone. Dat na why Assyria king fit distroy dem.

19 Naw, my Oga God, make Yu save us with yor pawa, so dat all di kingdoms for dis eart go know sey na Yu bi Oga and di only God wey nor dey die.”

20 Amos pikin, Profet Isaya kon send message go meet King Hezekaya sey, “Dis na wetin di Oga wey bi Israel God dey tok: ‘I don hear yor prayers about King Sennakerib for Assyria.

21 And dis na wetin I tok about am:

22 Na who yu dey trobol and curse like dis?

23 Yu send yor messenja make e kon boast for mi sey,

24 Yu dey boast sey yu dig well kon drink wota from strenjas land

25 Dem nor tell yu sey

26 Di pipol wey dey for doz land nor get pawa

27 But I know evritin about yu;

28 I don hear evritin about yor plan for mi

29 Den Isaya kon tell King Hezekaya, “Dis na sign of wetin go happen.

30 Doz wey remain for Judah go prosper like plant wey en rut enter groun

31 For Mount Zion and Jerusalem,

32 “So dis na wetin God tok about Assyria king:

33 Assyria king go-go back as e take kom.

34 Bikos of my own honor

35 For dat nite, God send en angel go kill 185,000 sojas for Assyria kamp. Wen day break, all of dem don die.

36 So King Sennakerib for Assyria run komot from di kamp. E go en house kon stay for Nineveh.

37 One day as e dey woship en god for Nisrok temple, en sons, Adrammelek and Shareza kon kill-am with dia swod, den dem run go Ararat land. Sennakerib pikin, Esarhaddon kon take-ova as king.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado