1 Samuel 2

PCM

1 Hannah kon pray dey sey,

2 Nobody dey holy like God!

3 Make una stop to tok anyhow;

4 Sojas swod don break to pieces,

5 Pipol wey dey chop well and get evritin before,

6 God dey kill and give life;

7 E dey make some poor kon make odas rish.

8 E dey karry weak pipol komot from san-san

9 E dey wosh and guide di pipol wey E choose,

10 God go skata en enemies;

11 Den, Elkanah and en family kon go back to Rama. But Samuel stay for Shiloh dey serve God with Eli wey bi di priest.

12 Eli sons dey wiked and dem nor dey do wetin God kommand.

13 Naw, na so di priest dey trit di pipol: Wen anybody dey make sakrifice, as di meat dey boil, di priest savant go kom with fork wey get three head.

14 Dem go put am inside di pot, basin or kettol and anytin wey di fork bring kom out, go bi di priest own. Dis na wetin dem dey do to all Israel pipol wen ever dem kom Shiloh.

15 Even before dem go burn di fat wey dey di meat, di priest savant go kom tell di pipol sey, “Make una give di priest some meat make e roast. E nor go take meat wey dem don boil from una, escept di one wey dem neva kook.”

16 If di pipol sey, “Make wi first boil di fat wey dey di meat, den yu fit take yor own komot,” di priest go sey, “No! Make una gi-am to mi like dat! If una nor give mi naw, I go use force take am!”

17 Eli shidren sin too plenty for God eye, bikos dem dey trit God ofrin anyhow without respet.

18 Naw, Samuel dey serve for God house. Di boy wear klean linen klot.

19 Anytime wey en mama kom with en husband to do sakrifice evry year, dem dey bring new dress for Samuel.

20 Eli go kon bless Elkanah and en wife sey, “Make God give yu many shidren thru dis woman and di shidren go replace Samuel wey yu dedikate give God.” Den dem go-go back to dia house.

21 So God really bless Hannah and e kon born three boys and two girls. Samuel grow for inside God house.

22 Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.

23 E kon tell dem, “Why una dey bihave like dis? Bikos I don hear all di bad tins wey una dey do.

24 My shidren, e nor suppose bi like dis, bikos di tin wey I dey hear about una from God pipol, nor dey good to hear.

25 If man sin against man, pesin fit beg God to forgi-am. But if man sin against God, na who go kon pray for am?” But di boys nor gri listin to dia papa, bikos God don sey E go kill dem.

26 So, Samuel kon dey grow and get favor from both God and pipol.

27 One man of God kom Eli house kon sey, “Dis na wetin God tok: ‘Wen Aaron and en family bi slave for Egypt, I show mysef to Aaron.

28 From all di tribes for Israel, I choose una grand-grand papa Aaron family to bi priest, so dat dem go serve and burn incense for mi, den kon wear di priest garment for my present. And I give dem di rite to take some from di sakrifice wey pipol dey burn give mi.

29 So wetin make dem get long-trot for di sakrifice and ofrin wey I sey make dem put for where I dey? Eli, yu don honor yor boys pass mi, bikos yu don make dem fat from di best part of meat from all di ofrin wey my pipol for Israel dey bring.’

30 “So, di Oga wey bi Israel God sey, ‘Aldo I tok sey yor house and yor grand-grand papa house go serve mi forever, but e nor go happen again! Bikos I go honor doz wey honor mi, but doz wey nor gri do wetin I tok, I go curse dem!

31 Make yu listin, di time dey kom wen I go kill all di yong men wey dey yor family and town, so dat no man for yor family go get long life.

32 Yu go si trobol for here wey I dey! Even doh I go bless Israel pipol, nobody for yor family go ever rish old age.

33 I go keep one man for yor family and e go serve mi as priest. But I go blind en eye; e nor go get hope and all yor shidren and shidren-shidren go die yeye deat.

34 “ ‘Wen yor two boys, Hofni and Finehas, go die for di same day, den yu go know sey evritin wey I tok, go happen.

35 Den I go choose one priest wey dey loyal. E go do wetin dey inside my heart and soul. I go gi-am shidren wey go always dey serve for front of di one wey I choose.

36 Evribody wey remain for yor house go kom bow for en front dey ask for money and food and dem go dey beg to help di priests, so dat dem go get food to chop.’ ”

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado