1 Crônicas 7

PCM

1 Issakar four sons na:

2 Tola six sons na:

3 Uzzi born Izrahaya

4 Dem get many wifes and shidren and dem still get 36,000 wariors.

5 All di wariors wey dem rekord for Issakar family na 87,000.

6 Benjamin born three sons:

7 Bela kon born five sons: Ezbon, Uzzi, Uzziel, Jerimot and Iri.

8 Beka born nine sons: Zemirah, Joash, Elieza, Elioenai, Omri, Jerimot, Abijah, Anatot and Alemet.

9 All of dem na leader for di family. Na 20,200 wariors dem rekord for di family.

10 Jediael born one pikin wey dem dey koll Bilhan.

11 Dem dey head dia family. Na 17,200 wariors dey ready for war for dis family.

12 Ir sons na Shuppim and Huppim. Na Aher born Hushim.

13 Naftali born four sons:

14 Manasseh girl-friend for Aramean born two sons for am and dem bi:

15 Makir marry wife for Huppim and Shuppim. (En sista name na Maaka.)

16 Maaka wey bi Makir wife, born two boys: Peresh and Sheresh. Peresh sons na: Ulam and Rekem.

17 Ulam pikin na Bedan.

18 Ramot sista, Hammoleket born three sons: Ishhod, Abiezer and Mahlah.

19 Shemida sons na:

20 Efraim shidren-shidren na: Shutela, Bered, Tahat, Eleada, Tahat and

21 Zabad Shutela.

22 Efraim wey bi dia papa kry for dem well-well and en brodas kon dey sorry for am.

23 E sleep with en wife again and e kon born and dem koll di pikin Beraya, bikos di family don face trobol well-well.

24 Efraim born one girl and en name na Sheerah. Na en build Uppa and Lowa Bet-Horon and Uzzen Sheerah towns.

25 Efraim still born one son, Refah.

26 Ladan, Ammihud, Elishama,

27 Nun and Joshua.

28 Dia propaty and lands na Bethel and di towns wey dey near am, go rish Naaran for di east and Geza for di west. Dem still stay for Shekem and Ayyah and all di towns wey near dem.

29 Na Manasseh shidren-shidren dey kontrol Bet-Shean, Taanak, Megiddo, Dor and di oda towns wey dey near dem. Josef wey bi Jakob pikin, na en shidren-shidren stay all dis towns.

30 Na Asher shidren-shidren bi dis: e born four sons:

31 Beraya born two sons:

32 Heba born three sons:

33 Jaflet still born three sons: Pasak, Bimhal and Ashvat.

34 En broda Shema sons na: Ahi, Rohgah, Hubbah and Aram:

35 While dia last broda, Helem born four sons: Zofah, Imna, Shelesh and Amal.

36 Zofah shidren-shidren na:

37 Beza, Hod, Shamma, Shilshah, Itran and Bera.

38 Jeta shidren-shidren na:

39 While Ulla shidren-shidren na:

40 All dis pipol na Asher shidren-shidren. Dem dey head dia family and dem bi popula sojas. Asher wariors na 26,000 just as dem rekord am.

Ler em outra tradução

Comparar lado a lado